I say them don come
Iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo
nothing we do them
Iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo
nigeria na my country iyo
Bayelsa na my state iyo
this na reality, well e been
happen for Bayelsa o
Nineteen ninty nine iyo
I swear I no go forget am o
when them kill the people o
and they make the children dem orphans o
anytime when I think am o
water dey pour from my eyes iyo
somebody say make I leave am o
but I say me I must talk am o
Chorus
I say dem don kill e dem mama eeeh
dem don kill e dem papa eeh
I say dem don kill e dem mama
dem papa, dem mama,
dem papa, dem mama eeh
I say dem don kill e dem mama
eeh, dem papa eeh ah, dem mama eeh ah
wetin we go do iyo, do iyo
say do iyo
Na so dey match dey go iyo
tem thousand for boat iyo
ask them where dem dey go o
them say them dey go Bayelsa o
which place for Bayelsa oh
one village dem call odi iyo
na him dem enter our village
dem rape our young girls
and make us homeless o
tchai them kill our mama iyo
them kill our papa iyo
them kill our brothers and kill our
sisters and make us homeless o
wetin we go do iyo, do iyo
say do iyo
everybody dey cry iyo and say
the government dem bad iyo
Chorus
I don die iyo, poverty no good at all iyo
everyday for Nigeria, na so the
people dem dey die iyo
our goverment o, why una make
us dey cry iyo ooh
everyday for Nigeria, na so the
people dem dey die iyo
commot for house for morning iyo
money no dey for your hand iyo
police go stop you for road
them go collect the one wey you get iyo
them lay allegation for head iyo
for wetin you no do iyo
before you go know
my brother you don dey inside cell iyo
(Repeat Chorus Till Fade)
Timaya - Dem Mama Lyrics
Africa Music Lyrics
( If you find errors and need to make corrections, pls submit Here )