Talking
Dis na one buka wey I dey like to go
The food sweet so tey e go make your mind blow
Day and night, Iya bass
How she do am I no no
Dem tink say na jazz, my brother no be so
Chorus
People, people, make una come e oh
Iya basira e don jazz me oh
Oh oh oh
Everybody helep save me oh
I no dey sabi chop either my mother or my girlfriend's food
People, people make una come e oh
Iya basira e go kill me oh
Oh oh oh
Everybody helep save me oh
I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food
Verse 1
No be so
I say na food go kill you
Wetin dey
Be say e get one day
Wey I say I go play go see my paddy Sunday
Na so I reach there but Sunday he don high on beer
Luckily for me in junior brother eye e clear
So e say make we stroll through the area
Little did I know I was strolling to my burial
right there where Oshodi bus dey load
Was a little buka, close to the main road
I laugh when e pass the door
He tell me say the name na “Iya Bas†for short
But I bow when he order
“iresi ati ewa, eran umum†pure water not even minerals
I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order second round, third round, fourth round
I never still stop wetin Iya Basira e give me chop
(Repeat Chorus)
No be so
I know, na food go kill you
Verse 2
You think say na play
When I say that the way wey I dey
(wetin do am?)
E no dey okay
Wetin be your own advice
I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice
Even on my girlfriends birthday
Wey she dey wait make I take am to Ocean View
I no know when I pass di place
The only thing wey dey my mind na Iya Basira's palm oil stew
Kilon kilon sele sele
Me I never see this kind, juju tele tele
All those people wey go vex pele pele
But I hear say iya basira na bele bele
I sure say still I go go their go sit down
Order my first round
Move to second round, third round, fourth round
I no dey ever stop
Wetin iya basira don give me chop?
Bridge
Officer I beg, follow me to the place
Everybody don tell me I dey craze
My girlfriend don leave me
My mother no gree see me, my paddy
Hmm, Iya basira you don kill me
Officer I beg, follow me to the place
Everybody don tell me I dey craze
My girlfriend don leave me
My mother no gree see me, my paddy
Hmm, Iya basira you don kill me
Oya, people, people, make una stop, officer, e don come
Policeman: where the woman?
People: E dey inside
Woman: Oga, I dey come.
Policeman: Woman na wetin you dey give people chop
Wey dey cause all this wahala
Casala oya make we talk.
Woman: Oga sir, true to God
Nothing wey I dey put for the food wey I dey cook
Na God dey make am good
Policeman: Na which kind talk be that
Say na God dey cook the food
Abi you think say I be fool
No be juju you dey put?
In fact, I dey suspect say na you wash put sotey
People dey queue come dey rush for your stew
Well, to confirm am
Me I no mind make I chop small
Give me fufu ninety naira plus dat soup wey dey draw
Chai, correct!
This food sweet no be small
She una no go vex if I still order for more
Woman: Officer no worry na de food be dis
Policeman: Oya, people, people, make una go case dismissed
(Repeat Chorus Till Fade)
Styl Plus - Iya Basira Lyrics
Africa Music Lyrics
( If you find errors and need to make corrections, pls submit Here )